Breaking News

‘I need justice for my pikin wey soldier allegedly kill for Kaduna’ – Victim papa share wetin happun

Di papa of one 16-year-old boy, Isma’il Muhammad, tok say im want justice for im pikin wey dem say soldier allegedly kill for Samaru area for Zaria, Kaduna State.... CLICK TO READ THE FULL NEWS HERE▶▶

Dem tok say di alleged shooting happun for morning for di boy house as soldiers dey patrol, afta di Kaduna State goment bin announce curfew becos of di protests wey turn violent.

Di late Isma’il Muhammad, wey be 16-year-old boy, dey live for Samaru area for Zaria Local Goment Area of Kaduna State.

E just finish junior WAEC exams and e bin wan kontinu im education for higher institution.

Bifor e die, e dey learn tailoring wit im broda Nazifi Muhammad to support imsef.

Wetin be di implication of waving Russian flag for Nigeria?
‘I call my son to come die’ – Woman share how her son die for Kano protest
Why di ‘hunger protests’ turn violent for northern Nigeria?

For di day wey di incident happen, Isma’il and about five odas dey sit down for front of dia shop, near dia house, wen soldiers arrive.
Foto of di bullet

Wia dis foto come from, Nazifi Muhammad
Wetin we call dis foto, Bullet wey bin kill Isma’il

Isma’il papa, Muhammad Husaini, tok say e no dey house wen di incident happun but dem call am tell am, wey make am rush comeback.

Husaini tok say, “Wen e happun, di children dey for front of dia shop wey no even near di road wen soldiers come patrol di neighbourhood behind Samaru market. Di children run inside afta dem see di soldiers.

“One of di soldiers point im gun at dem and tok say e go shoot. Di children run inside and lock di door.”

E say even though dem enta house lock di door, di soldier shoot di door twice, and “na im kill Isma’il”.

Husaini add say, “Di bullet hit am for im neck and back, and wen di soldier hear am scream, e waka comot.”

Di papa tok say e want make dem do justice for im son wey di soldier bin kill.
Di door wey di soldier shoot at for Isma’il house

Wia dis foto come from, Nazifi Muhammad
Wetin we call dis foto, Di door wey di soldier shoot at

One eyewitness, Nazifi Muhammad, wey be Isma’il broda, tok say dem dey togeda wen di incident happun.

“We enta house and lock di gate, but di soldier follow us reach our house and shoot twice. One bullet hit am for back, and di oda one hit am for neck.”

“We carry am go outside to show di soldiers wetin happun. At first, dem deny am, but later dem accept say na one of dem do am,” Nazifi talk.

Di Commanding Officer of di Nigerian Army 1st Division, Major General MLD Saraso, visit di boy family to sympathise wit dem.

Di Nigerian Army don announce say dem don arrest di soldier wey dem accuse of killing di young boy during dia patrol for Samaru area for Zaria, Kaduna State.
Witness Invite letter from di Nigerian Army

Wia dis foto come from, Nazifi Muhammad
Wetin we call dis foto, Letter wey Nigerian Army dey invite di witness to come give dia statement

About the author

Bunady

1 Comment

  • I am not sure where youre getting your info but good topic I needs to spend some time learning much more or understanding more Thanks for magnificent info I was looking for this information for my mission

Leave a Comment

0 Shares