News In Diaspora

Israel and Iran: From proxy war to fears of regional gbege

Rescue workers for di site of one airstrike for Damascus, Syria, 01 April 2024
Wetin we call dis foto, Rescue workers for di site of one airstrike for Damascus, Syria, for April dis year... CLICK TO READ THE FULL NEWS HERE▶▶

Di war between Israel and di Palestinian group Hamas don cause tensions to increase for di Middle East.

External players, wey dem don notice well well na Iran and dia regional proxies, wey don also dey involved for di conflict.

Iran deny say dem dey involved for Hamas attacks on Israel on 7 October, but dem express support for wetin dem call di “devastating earthquake” against Israel.

Iran no engage in direct confrontation wit Israel at first. However, Israel find diasef inside direct and indirect conflicts wit groups wey Iran dey support, wey describe demsefs as di “Axis of Resistance”.

Dem include Hezbollah for Lebanon, di Houthi movement for Yemen, and various armed groups for Iraq.

Many of dis groups dey proscribed as terrorist organisations by di US, UK and oda kontris.
Hezbollah role for di conflict.

Wia dis foto come from, Reuters

Israeli positions for Shebaa Farms
Wetin we call dis foto, Shebaa Farms for di Golan Heights

Di war for Gaza bring back tensions between Israel and Hezbollah, and Hezbollah start to target northern areas of Israel “to support Hamas”.

On 8 October, just hours after Hamas initial attacks, Hezbollah launch attack on di Shebaa farms, one territory wey Israel dey occupy.

Hezbollah soon declare dia support for di 7 October attacks wey Hamas do, dem tok say dem dey in direct contact wit di leadership of di “Palestinian resistance both inside and outside” di region.

Di Israeli army quickly respond to di Shebaa Farms attack as dem target one Hezbollah tent for di area, wey make some Lebanese citizens wound according to di Lebanese army.
Di Houthis join di collabo

About one month into di Gaza war, Yemen Houthi movement chook head for di conflict against Israel.

On 14 November, Houthi leader Abdul-Malik al-Houthi bin announce say in response to di fighting, di Houthis go target any ships owned or wey Israeli companies dey operate.

Di Houthis later expand dia operations to include all ships wey dey head towards Israel for di Red Sea, particularly near Bab al-Mandeb strait, one strategic global maritime route.

Dis attacks bin get significant impact on global trade, e force ships to change dia roads thousands of miles.

For December 2023, di Houthis bin claim say dem bin attack two Israeli ships wey ignore dia warnings from dia naval forces.

Di group later capture one ship wey one Israeli businessman get weeks earlier.

For January dis year, di US bin conduct one airstrike for Yemen, sake of one Houthi missile attack on one British oil tanker for di Gulf of Aden.

Di Houthis bin claim say US and British aircraft bin target di Ras Issa oil area for Yemen western province of Al Hudaydah.

Na part of one series of strikes by di international coalition, wey dem bin form to protect maritime movement for di region.
Israel begin assassinations for Lebanon

Wia dis foto come from, EPA

Mourners carry di coffin of Hamas deputy leader Saleh al-Arouri
Wetin we call dis foto, Mourners carry di coffin of Hamas deputy leader Saleh al-Arouri

Di situation kontinu to increase more and more, while Israel increase airstrikes for Lebanon.

On 2 January 2024, Israel bin launch one airstrike for Beirut mainly di Shia southern suburb of Dahiyeh, dem kill Saleh al-Arouri, di deputy head of Hamas and di leader for di West Bank.

Israel bin describe Arouri as di key link between Hamas and Hezbollah.

Just days later, Hezbollah bin launch approximately 40 rockets for Israel Meron Airbase for di north, dem call am “preliminary response” to Arouri assassination.

On 8 January, one Israeli airstrike kill Wissam al-Tawil, di deputy commander of Hezbollah Radwan Force, wey dem bin accuse of plotting di attack on Meron Airbase.
Iraqi Shia factions weigh in

For late January, dem bin kill three US sojas for drone attack on one US military base wey dem sabi as “Tower 22” for north-eastern Jordan, near di Syrian border, and 34 odas bin wound.

Jordan deny say di attack happun for dia territory, dem state say na for Syria e happun.

US President Joe Biden bin condemn di attack, im insist say extremist militant groups wey Iran dey support, wey dey operate for Syria and Iraq, get hand inside. Im bin vow say di US go hold all di pipo wey get hand inside to account.

Kataib Hezbollah, and Iraqi militia bin claim di attack wey di US say Iran Islamic Revolution Guard Corps (IRGC) dey oversee – even though di extent of Iran influence over dem no dey clear. Iran deny to support di group wey US hold responsible for di attack.
Iran direct involvement

Wia dis foto come from, Reuters

Pipo gada near di wreckage of Iran consulate for di Syrian capital Damascus April 1, 2024
Wetin we call dis foto, Collapse of di Iranian consulate for Damascus

Iran deny di right of Israel to exist, but dem bin don avoid direct confrontations wit Israel bifor.

However, for early April, Israel bin attack Iranian consulate for Damascus, dem kill, oda pipo, many officers of di IRGC. Di pipo wey bin die include di high-ranking Brigadier General Mohammad Reza Zahedi.

Later dat month, Iran launch dia first direct attack on Israel, dem use drones and cruise missiles. Iran bin claim say na Israeli airbase for di Negev dem bin target.

Di Israeli army bin tok say most of di missiles bin dey intercepted bifor dem reach di Israeli territory.

Dem respond wit limited strike on one air defence system for Iran – though Israel no officially claim responsibility for di attack.
Increased threat to di region

From late June to early July dis year, tensions between Hezbollah and Israel increase well-well. Di group increase dia attacks and more members of dia ranks bin suffer assassination.

On 7 July, Hezbollah fire plenti rockets into northern Israel, including one strike on Israel Meron Airbase.

Later dat month, 12 children and young adults die for di rocket strike wen dem bin dey football for di Israeli-occupied Golan Heights.

Hezbollah deny responsibility, but Israel respond wit air strikes against seven Hezbollah targets for Lebanese territory.

For July, Israel most significant confrontation wit di Houthis wey Iran dey support happun wen Israel bin bombard di Houthi-controlled Red Sea port of Hodeidah for Yemen.

Di attack bin kill nine and more dan 80 pipo wound. E bin happun a day afta one group launch hit Tel Aviv and kill one pesin and eight more pipo wound.

Di month end with two assassinations. Hezbollah military commander, Fuad Shukr, die for airstrike for Beirut southern suburbs.

Hours later, dem kill Hamas leader, Ismail Haniyeh, during im visit to Tehran wia e bin go attend di inauguration of Iran new president.

Iran accuse Israel of di assassination, even though Israel no claim responsibility.

Dis series of events don fuel speculation about weda dis long-standing tension between Israel and Iran fit turn into a larger-scale direct confrontation wey fit cause big kasala for di entire region.

About the author

Bunady

Leave a Comment

0 Shares